Bola Tinubu
Man abi wuman | man |
---|---|
Kontri wey e kom from | Naija |
Nem for lokal langwej | Bola Tinubu |
Orijina nem | Bola Ahmed Tinubu |
Fest nem | Bola, Ahmed |
Wen dem bon am | 29 March 1952 |
Ples wey dem bon am | Lagos |
Mama | Abibatu Mogaji |
Pesin wey e mari | Oluremi Tinubu |
Fest langwej | Yoruba Langwej |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Yoruba Langwej |
Langwej wey e tek rait di wok | British English |
Wok wey e dey du | accountant, politician, Presido of Naija |
Wu e dey wok for | Arthur Andersen, Deloitte, GTE, Mobil Producing Nigeria |
Post wey e dey | member of the Senate of Nigeria, Lagos State Governor, Presido of Naija |
Wie e go skul | Chicago State University |
Party wey e dey for politis | Alliance for Democracy, Action Congress of Nigeria, All Progressives Congress |
E pipul | Yoruba pipul |
Rilijon | Islam |
Bola Ahmed Adekunle Tinubu na Naija politishan an di presido of Naija. Bola Tinubu na di nomba 16 pesin to bi Naija presido.[1][2] Tinubu don bi govno of Legos Stet bifor bifor from 1999 go rish 2007. Tinubu don bi Senato for Lagos West for di Third Republic wey no last. Na Bola Tinubu dem chuz for All Progressive Congress as dia kandidet for di 2023 Naija Presido eleshon. Na for Sautwes Naija Tinubu gro bifor e kom go United State (USA) go rid Akauntin for Chikago State Univasiti . Tinubu kom bak to Naijá araund 1980 an e get wok for Mobil Nigeria as akauntant, bifor e join politis as pesin wey Social Demokratik Pati pik as dia Lagos Wes senatorial kandidet. Afta Sani Abacha tok sey e no wan see Senaet again for 1993, Tinubu dey among di pipul wey fait mek demokrazi kom bak as e join di"Nachonal Demokraci Koalishon muvment. Di Tru mata bi say, Tinubu nid run komot from Naijá for 1994, e kom bak wen Abacha kpai for 1998 an na dis one stat di biginin of Fourth repoblik. For di gofnor eleshon wey dey du for 1999, Tinubu wey bi memba of "Alaians for Demokraci" (AD) win ova di Pipos Demokratik Pati" (PDP) kandidet Dapo Sarumi an di kandidet of "All Pipo's Pati" (APP) Nosirudeen Kekere-Ekun. Afta Four years, Tinubu win di sekond eleshon for di sekond tem ova di PDP kandidet Funsho Williams. Di main tori of Tinubu as govno of Legos Stet bi hau e wan mek Legos Stet Mega siti an e fait wit Fedral Govment wey PDP kandidet dey kontrol. Afta wen Tinubu liv ofis, e bi among di oga-dem wey fom di politikal pati "All Progresiv Kongres" for 2013. Pipul dey always get kweshon on Tinubu karia if e get magomago an di tori abaut e life.
Tori abaut e life an skul wey e go
chenj-amAkordin to di pepa wey dey kot, dey bon Tinubu for March 29, 1952. Tinubu mama na Abibatu Mogaji wey leta bikom di Iyaloja of Legos Stet.Tinubu go St.John's Primary School, Aroloya wey dey Legos an Children Hom Skool for Ibadan. Tinubu travul go abrod whe e go Richard J.Daley kolej for Chikago den Chikago State Univasiti. E get di sartifiket Bachelor of Science (BSc.) for Akauntin. Pipul no too suo abaut Tinubu wen dey bon Tinubu, di skul wey e go an e ril nem bikos meni dokument an wetin Tinubu sef dey tok abaut am no mek am klair at all. Dem say na anoda famili wey dey Osun State bon Tinubu an say e ril nem no bi Bola Ahmed Tinubu an say na lai e dey tok abaut e histri, bot all dis one na dem say dem say. Dis "Dem say, Dem say stat wen Tinubu somit e pepa to INEK (Independent Nachonal Eletoral Komishon) wen e wan go for govno for 1999. Di pepa lai say Tinubu go Govment Kolej Ibadan an di rekod wey dey Chikago State Univasiti tok say na 1954, no bi 1952 dem bon Tinubu. Wen dey tel Tinubu mek e tok wetin hapun, e tok say Tokubo Afikuyomi mek mistek wen e somit e pepa giv INEK an say Chikago State Univasiti du mistek wen dem dey rait e age. Di mata stil kom up wen Tinubu rilis e pepa to INEC for 2022 as e wan go for president bikos e no put e pramari an sekondri skul wey e go dis taim araund wen e dey put dem bifor.
How e tek wok an tori abaut e drug mata
chenj-amTinubu don wok for di folowin kompini:
- Arthur Andersen
- Deloitte, Haskins & Sells
- GTE Service Corporation
- Mobil Oil: Tinubu join Mobil oil wen e reton to Naijá an e leta bikom one of di oga-dem wey get maut for di kompini.
Wen Tinubu dey USA for ovasea, di Govament for ovasea chek Tinubu bank akaunt an tok say e hand no Klin bikos of di big moni wey dey inside am. Di Govament kom blok di akaunt wit di moni wey rish $460,000 for di year 1993. Di Govament blok di akaunt bikos Tinubu dey hep sel Had drug for two Chikago dila for di eli 1990s.
How e tek stat politis
chenj-amTinubu stat to join politis for 1992 wen e join "Soshal Demokratik Pati"(SDP). Tinubu na memba of di grup wey Shehu Musa Yar'adua dey kontrol inside SDP parti. Oda politishan wey dey di politikal pati na Umaru Yar'adua, Atiku Abubakar, Baba Gana Kingibe, Rabiu Kwankwaso, Abdulahi Aliyu Sumaila, Magaji Abdulahi, Dapo Sarumi an Yomi Edu. Tinubu bikom Senate wey dey repiset Lagos Wes Konstituensi bifor di Naijá third ripoblik skata. Wen dey skata di risot of June 12, 1993 presidenta eleshion, Tinubu kom join oda politishan fom di pati Nachonal Demokratik Koalishon(NDC). Di grup na pipul wey dey fait mek demokrazi kom bak to Naijá an mek dey mek Moshood Abiola di presido of Naijá as dey biliv sey na Abiola win di June 12 eleshon. Abiola run komot from Naijá wen jeneral Sani Abacha bi presido for 1994 an kom bak for 1998 afta Abacha don kpai. Na dat taim di Fourth Naijeria Repoblik stat. Bifor di 1999 eleshon, Bola Tinubu na boi of Abraham Adesanya an Ayo Adebanjo an dey bi di lida of di pati "Alaians for Demokrasi" (AD). Tinubu win di pramari eleshon wey di pati du to chuz bitwin Tinubu, Funsho Williams and Wahab Dosunmu wey bi forma minista of woks and hausin. Tinubu bikom di Govno of Legos Stet for Januari 1999 onda di AD pati.
Govno of Lagos State
chenj-amTinubu bikom di govno of Legos on May 1999 an e promis sey e go mek 10,000 haus dey for poor pipul to stay. For di 8 years wey Tinubu yuz as govno, e put moni for edukaeshon an giv bak som skool to dia forma owna. Tinubu stat niu road as e plan to mek Legos get propa road bikos of di nomba of pipul for Legos. Tinubu wit e sekond in komad, Femi Pedro win di sekond tem eleshon as e enta ofis as govno for April 2003. Na onli Legos State PDP no win for all di State wey dey Saut-Wes. Wahala dey bitwin den presido Olusegun Obasanjo of PDP an Tinubu of AD wey Legos Stet sopoz fom adishonal lokal govament bikos of hau pipul tek plenti inside di Stet. Bikos of di palava, forma presido Obasanjo no gri giv Legos Stet dia moni wey fedral dey giv Stet to giv dia lokal govament. As e taim as govno dey kom to end, Tinubu enta meni kuore wit PDP politishan laik Adeseye Ogunlewe wey bi forma Legos senator wey bi minista for wok an hausin at dat taim, an Bode George, wey bi head of PDP for Saut-Wes. Di luv wey Tinubu an Femi Pedro get for one anoda stat to wik wen Femi Pedro tok sey e sef wan bikom govno of Legos. Dis one mek Femi Pedro go join anoda pati kol Labour Pati (LP) wen e stil bi vais govno. Tinubu taim as govno of Legos Stet finish on May 29, 2007 wen e leav di posishion for Babatunde Fashola of Akshon Kongres (AC).
E bank akaunt for oyibo kontri palava
chenj-amFor April 2007, afta wey di jeneral eleshon don finish, di fedral govament kari Tinubu go Koud of Kondot Bureau sey mek e tok hau e tek get 16 difren difren bank akaunt for oyibo kontri.
Lagos moni an e shia for Ekonet
chenj-amFor Januari 2009, EFCC (Ekonomik and Fainanshal Kraims Komishon) chek Tinubu, govno of Delta James Ibori, govno of Akwa Ibom Obong Victor Attah weda dey yuz Stet moni, dia pawa as govno tek bai shia for V-mobile kompini for 2004. E get one ripot wey som pipul get say dem wan kil Tinubu on March 2009. Di pati AD ( Alaians for Demokrasi) ripot di mata to den inspeto of polis Mike Okiro mek e luk di mata wel wel. For September 2009, British Polis tok say dem wan chuk ai inside hau Legos Stet Govament tek bai shia for Ekonet (wey bi Airtel for nau). Tinubu tok say no magomago dey am an say na all di pipul for Legos go gain inside wetin dem du. Naijá Fedral govament no gri kopuret wit British Polis to investiget di three forma govno for London kot.
Godfada an hooligan for Legos Stet
chenj-amPipul dey tink sey Tinubu na godfada of Lagos wen wi tok abaut politis mata for Legos. E get one sho for AIT televishon wey kari di tori wey di taitu na "Di Laion of Bourdilon". Di AIT sho na 2015 Dokumentri wey tok abaut hau Tinubu dey kontrol politis an moni wey Legos Stet get. Tinubu kari di produsa of di sho go kot an e tok sey dem mos giv am ₦150 billion for hau dat sho tek lai an spoil e nem. Dem kansu di AIT sho on March 6, 2015. Di kays of Fashola sekod tem kuorel wahala wit Tinubu as Tinubu wan mek Muiz Banire (wey bi forma envarometa komishona) to bi govno instead of Fashola for 2015 kom mek pipul tink sey e na godfada of Legos Stet. Anoda kuorel bitwin Fashola an Tinubu hapun as Tinubu dey kampain for Akinwunmi Ambode an Fashola dey kampain for anoda pesin. Anoda tin wey mek pipul tink sey Tinubu na godfada bi hau Akinwunmi Ambode tek komot as govno an hau e tek arenj mek di niu govno Babatunde Sanwo-Olu enta ofis as govno.
Tori abaut Bullion van an eleshon for Lagos
chenj-amWen 2019 eleshion dey go on, meni pipul see Bullion van enta di ples wey Tinubu dey liv for Bourdilon road for Ikoyi. Wen dey tel Tinubu mek e tok abaut am e tok sey "I fit put my moni eniwie wey I like" .
Politis
chenj-amFor 2016, Tinubu tok to Atiku Abubakar wen e stil bi vais president sey mek e leav PDP an kom e politikal pati to kampain for presido of Naijá. Atiku gri to join Tinubu for e pati bot e no chuz Tinubu as e sekond bot go for Ben Obi wey kom from Saut-Eas as e sekond. Atiku no win di eleshon as PDP win for di eleshon. Wen Tinubu see say e pati no win di 2007 presidetal eleshon, Tinubu stat to dey join oda pati togeda so dat all di smol pati ga fit fom one big pati to tek shalej PDP for 2019. For Februari 2013, Tinubu don hep mek three smol smol pati join to fom one pati. Di pati bi: Akshon Kongres of Naijeria (ACN), Kongres for Progresiv Chenj (CPC), All Naijeria Pipos Pati (ANPP) an smol smol pat of All Progresiv Grand Alaians (APGA) an niu PDP (nPDP) Di nem of di niu pati wey dey fom na All Progresiv Kongres (wey for Ínglish bi APC). For 2014, Tinubu join hand wit forma militri hed of state Jeneral Muhammadu Buhari wey bi lida of CPC pati wey join fom APC. Buhari don kampan to bi presido for three taims bifor (for 2003, 2007, 2011). Tinubu bifor wan bi Buhari vais bot leta chenj e mind an e pik Yemi Osibanjo to bi Buhari vais. Yemi Osibanjo na Tinubu frend an e na forma komishona of jostis. For 2015, Buhari win di eleshon onda di APC pati an Buhari win end di sixteen years wey PDP don dey kontrol Naijá. Buhari wey win mek am di fes taim wey anoda pesin wey no bi president win presido of Naijá for Naijá histri. Tinubu play meni pat for Buhari Govament, as e sopot meni aidia as pipul dey tok say e bi laik Tinubu sef wan go for presidet too. For 2019, Tinubu sopot Buhari to fit win PDP kandidet Atiku Abubakar. Wen wahala hapun for APC pati, dem remuv Tinubu frend wey also bi APC pati Chairman Adams Oshiomole as Chairman an meni pipul kom dey tok say na plan mek Tinubu for no fit kampain to bi Presido for 2023.
Plan to bi 2023 Naijá Presido
chenj-amFor Januari 10, 2022, Tinubu mek President Buhari no say e get plan to bi di Naijá Presido for 2023. On June 8, 2022, APC pati tok say na Tinubu win di pramari eleshon as e get 1,271 winni Vais Presidor Yemi Osibanjo wey get 235 an Rotimi Amaechi wey get 316.
Pasonal laif
chenj-amTinubu na muslim. Tinubu waif na Oluremi Tinubu wey been dey reprisent Lagos Central Senatorial distrit for senaet. Tinubu mama Abibatu Mogaji kpai wen shi bi 96 years for June 15, 2013. Tinubu pikin Jide kpai for London wen e get hart atak for dia.
Chif taitu
chenj-amTinubu na Asiwaju of Legos an di Jagaban of Borgu kingdom for Naija Stet for Naijá.
Wie dem gada di tori
chenj-am- ↑ "Nigerians don Get New President, Bola Ahmed Tinubu". Wazobia FM. Retrieved 2024-09-19.
- ↑ "Bola Tinubu inauguration: Pictures of how Tinubu swearing in ceremony happun". BBC News Pidgin. Retrieved 2024-09-19 – via www.bbc.com.